Friday 25 September 2009

Oga Umoru Coolu Temper

Naija country people sef na their mouth dey put dem for trouble. Dem say our Oga Pata Pata for Naija, Oga Umoru dey drag leg for how he dey rule us and dem don tire for the waiting to see 7- point Agenda for ground. As Oga Umoru dey try to beg those Niger Delta boys make dem bring their guns make dem collect gbem, some Naija people come dey tink say he no get liver.

As Gambari people last two years dey happy say na their turn to share the cake, e be like say many of dem don confuse about how some Naija people no get the same value again. Gambari wey dey for Tin City first taste the bitter medicine wen dey say dem no gree for election magu magu . Why dem dey complain? As dem dey talk am charity dey start for home. When Boco haram wan fight gofment, dem deal with dem squarely, forget rule of law as e dey temporary out of service.

The next Gambari people to taste freedom for democracy be for Power state as police move go their help Oga Chief Servant sack the people of Darul –Islam, no ask me wetin constitution talk, rule of law na him dey work. Presently ebi like say na the turn of Shiites as even one of their Oga dey beg say make dem no bomb im house with his aged Mama and small pickins. Dem no even no say to support Palestine people dey dangerous and Police no get budget for batons, teargas and rubber bullets. Rule of law? Not available at the moment.

Even those little little boys wey dey always make noise like the former Oga Honourable from Birnin –South are picked, sorry invited to city of milk and honey to drink tea. Lecturers unions, dem tink say because Oga Umoru carry chalk before dey go fit force am to do wetin dem want education to be. If dem never decide na their wahala as if dem no run back to class, no salary.


If Naija people get plenty sense dem go know say Oga Umoru don dey change from wetin dem dey call slow motion to active Commander-In –Chief which even the late dark goggled General envy go catch am. Mending boys and their likes wey dey carry guns should now run for cover before amnesty finish. Federal character must be implemented abi? And dey cannot disgrace Oga Pata-Pata by stopping him to fulfill three of his 7-Point Agenda, Niger Delta, Electricity and Wealth creation.

Recently, One Oga Ambassador wey be all round Minister talk am for BBC Gambari service , promise to take BBC Gambari Oga Madam to every lungu and corner of Naija before year finish to show her how Naija people dey enjoy NEPA light , just say amen!

To those accusing Oga Umoru about not working hard to realize 7 –Point Agenda. Make dem wait small, may be as Oga Ambassador promise electricity on behalf of Oga Pata Pata by end of dis year , Oga Umoru don work very hard on other remainings of 7 –Point Agenda , Health and Education. May be by next year sef Oga Umoru go fit enter any Naija hospital make dem do am medical check up, no more waka to Saudi Arabia. Our schools for don better and Oga Umoru go comot im pickins from money schools to gofment awuf schools. The schools go don better and dem dey work well well dat Oga Ambassador go fit add the tins weh he go show BBC Gambari madam make she se with her koro-koro eyes.

Some Naija people dey complain say gofment dey carry people even if dey no beg from one state to another free of charge. For Plateau state dem carry Fulani people and their malu for big moto take dem back to their real motherlad. Almajiri people own even better as dem give dem free ride from places like Lagos, Abuja and Kaduna go keep for their origin . We no go join Darul –Islam people join with dis one. You know say our lawyers know book well well , Adieu Gani !

Gofment no get money for the demands weh lectures, teachers, doctors, civil –servants dey look for. Gofment no get money, na the small money weh gofment dey get to take kia of politicians and public office holders, na him dem want Oga Umoru gofment share with dem? Some dey even complain say where fia-fia Oga Bank pata pata get 400 billon he put for banks weh he call am debt? If gofment push neck agree to Labour people demand of 52,000 naira as smallest salary come join money wey university people, teachers, doctors dey demand , wetin go remain for gofment pocket? If you get black stomach for wetin politician dey get, resign go stand for election make tins better for you.


Oga Umoru gofment no want waste, dat’s why I put my ears for ground for my state weh get highest numbers of people weh dey share Naija cake. Dem hand open well well and people no even complain say from the big ones to the small small ones give dem pure water to break their fast. Even as people for the other side no fit share cloth, rice , kayan shayi and small change, Oga Umoru people dey try with the small salary weh dem dey collect. No mind dat rag-tag plumber turn politician weh seize the umbrella from Oga Pata Pata people.


2011? So wetin go happen ? Oga Umoru no dey fear any type of election. The magic weh Oga Umoru dey take use for Katsina dey and he come join dem now with the better better work weh he dey do . And another extra one even dey as market men of religion go even fit give decree say any Naija person weh no vote for Oga Umoru go remain forever for hell- fire. What if he no gree to contest for 2011? No worry more tan two million Naija people go march go Abuja beg am make he help us fr Naija continue with the work weh he don start.


Me, the tin weh dey fear me with Oga Umoru gofment na dey bloodshed, many people don quench from Pateau, Nige Delta, Bauchi, Yobe, Kano, Borno, Kaduna, Sokoto states. All the killings can be stopped through good gofment policy. Gofment from top to bottom should be merciful to their country people, excessive use of force led leaders like Pot, Najibullah, Saddam, Mobutu, Bokassa, Shah, Mussolini, Hitler, Abacha, Bush e.t.c to be listed in the hall of bad guys in history. Our Ogas should rule with wisdom and mercy so dat history should be merciful to dem.


Oga Umoru e never late for you to perform wonders in less than two years to come. Comot money improve masses lives through creating work, better hospitals with medicine, paying real wages to our workers, better condition to learn and read book and so many better tins weh Naija people dey request for.


E go better also if Oga Umoru take wayo say sorry to Naija people for all the wahala of the past two years and promise dem say e no go happen again. Oga Umoru Coolu temper, as Naija people want good tins of life as you don promise dem, we dey wait make we see better for ground.


Shehu Mustapha Chaji
shehuchaji@yahoo.com

No comments:

Post a Comment